Shey una dey feel the heat for this month, even NEPA no wan gree us enjoy small breeze. For some place Na Spring dem dey call am and e dey start from March. This season dey bring to our awareness if una no know say na Spiritual Wellness Month. Yes the entire of March from 1 - 31 dey mark Spiritual Wellness.
Spiritual wellness na wetin each pesin define for imself; but e dey about dat search for peace inside your heart.
De plan na to check whether your beliefs, your hustle, family, friends, all dey line up well.
When we dey spiritually strong, we no just connect with God, but with people around us, cos e dey make de link between our mind, body, and spirit sweet pass.
Dis month before e go end, I dey ginger you to take small time think about wetin dey give your life purpose, meaning, happiness, and peace.