Home
Community
Explore
Chats
Notifications
Bookmarked
RegisterLog In
About AMAKA|For Creators|Advertise|Terms & Privacy|Policy & Safety

© 2025 AMAKA Studio Ltd

HomeExploreChatsGigs
Banner

Top 10 5G Smartphones Wey You Fit Buy for Under ₦200,000 for Naija in 2025

Puplished 15th August 2025

Asabe Kabir

Asabe Kabir

@PidginInspiration

As 5G network dey spread gidigba for Naija now, e mean say many people dey find smartphone wey fit carry the fast internet speed well well. But you no go need break your bank to get one correct 5G phone wey get better display, good camera, and strong battery. I don gather list of the top 10 best 5G phones under ₦200,000 wey you fit buy for Naija dis year.

1. Samsung Galaxy A33 5G

Price dey between ₦173,000 to ₦190,000. This phone get 6.4 inch Super AMOLED screen wey smooth well well, Exynos 1280 processor. E get 6GB RAM and 128GB storage, plus 48MP quad rear camera to snap better pictures. Battery na 5,000mAh and e get fast charging of 25W.

2. Tecno Camon 19 Pro 5G

This one sharp for photography lovers. Price na about ₦195,000 to ₦199,000. Screen na 6.8 inch FHD+ IPS LCD with 120Hz refresh. E get 8GB RAM and big 256GB storage. Camera sharp with 64MP back and 16MP front camera. Battery na 5,000mAh with 33W fast charge.

3. Nokia X10 5G

Price dey around ₦160,000 to ₦175,000. Screen 6.67 inch IPS LCD. Snapdragon 480 power the phone, e get 6GB RAM and 128GB storage. Camera system get 48MP quad back and 8MP front. Battery 4,470mAh. This phone no get plenty wahala, e good for people wey like pure Android.

4. Infinix Note 12 Pro 5G

This one price dey go up to ₦200,000. E get 6.7 inch AMOLED display, MediaTek Dimensity 810 processor, 8GB RAM and 128GB storage. The main camera na 108MP, which dey rare for dis kind price range. Battery na 5,000mAh with 33W charging.

5. Nokia G60 5G

Price range be from ₦190,000 to ₦197,000. E get 6.58 inch IPS LCD screen with 120Hz refresh. E dey power by Snapdragon 695 with 6GB RAM and 128GB storage. Him Camera system get 50MP for back and 8MP front. Battery na 4,500mAh.

6. Infinix Zero 5G (2023)

Price na between ₦160,000 to ₦170,000. E get 6.78 inch IPS LCD screen, MediaTek Dimensity 920 processor, 8GB RAM, 128GB storage. Camera get 50MP back and 16MP front. Battery na 5,000mAh with 33W fast charge.

7. Tecno Pova 5G

Price na ₦145,000 to ₦155,000. Big screen of 6.9 inch FHD+ IPS LCD. 8GB RAM and 128GB storage. Camera 50MP back, 16MP front. Battery no dey play, 6,000mAh but charging slow sha - 18W only. This one go make sense for people wey need long battery life.

8. Tecno Spark 10 5G

Very affordable for ₦120,000 to ₦130,000. Screen na 6.6 inch HD+ IPS LCD, 90Hz refresh. MediaTek Dimensity 6020 processor. RAM 8GB, storage 128GB. Camera 50MP back, 8MP front. Battery 5,000mAh.

9. Oppo A74 5G

Price na between ₦140,000 to ₦150,000. Screen 6.5 inch IPS LCD with 90Hz. E dey powered by Snapdragon 480, RAM 6GB and storage 128GB. Camera system 48MP quad back, 16MP front. Battery Na 5,000mAh.

10. Vivo V23e 5G

Price around ₦185,000 to ₦195,000. E get nice 6.44 inch AMOLED screen. MediaTek Dimensity 810 processor powers am. 8GB RAM and 128GB storage. This one sabi selfie well with 44MP front camera and 50MP back. Battery 4,050mAh with super fast 44W charging.

For Naija, these phones show say you fit enjoy 5G internet without spending too much. Whether na for camera, battery, or gaming, una fit find one wey fit your style under ₦200,000. Make sure sey you check price well and buy from trusted sellers. I no wan hear story dat touches the heart.

TechnologyBusinessWritingPhotographyArtificial Intelligence
10011

Begin story discussion0

You