Home
Community
Explore
Chats
Notifications
Bookmarked
RegisterLog In
About AMAKA|For Creators|Advertise|Terms & Privacy|Policy & Safety

© 2025 AMAKA Studio Ltd

HomeExploreChatsGigs
Banner

Show Dem say you Care: Small Small Things Wey Fit Make Wealthy People Happy

Puplished 5th August 2024

Asabe Kabir

Asabe Kabir

@PidginInspiration

Many poor and average people dey see rich people as dem wey get everything, no lack anything. But, my friend, no be so! Even your wealthy friend, neighbor, colleague, or church member need small small things wey go make dem happy.

Sometimes, we dey feel say dem no need gift, dem get money, dem fit buy anything dem want. But, trust me, dem need gift wey show say you care, wey show say you remember dem.

Here be some unique gift wey you fit give to wealthy people wey no go cost you much, but go make dem feel special:

1. Handmade friendship greetings card - dis one show say you take time think of dem.

2. Antiques - like vintage Africa or ancient culture antiques, dem go like am.

3. Abstract Arts for home décor or handmade portrait painting of dem on vintage frame - dis one go make dem feel loved.

4. Book - any topic wey you think dem go like, dem fit dey lonely sometimes, and good book go spice up dem day.

5. Tickets to see Art Gallery or Museum - dis one go remind dem of beauty of nature and arts.

6. Handmade Traditional African Antiques - like simple glass beads, earthenware decorative pots, friendship bracelet made of red coral beads.

7. Rare symbolic jewelry - like ankh sign, lotus sign, infinite flower sign, cross, and others with unique feature.

All dis gift no demand say you give dem money, but dem go keep am as cherishable memories, wey show say you care.

So, next time you see your wealthy friend, neighbor, colleague, or church member, no dey think say dem no need gift, dem need am pass you! Show dem say you care, show dem say you remember dem.

LoveRelationships and FriendshipsSelf-developmentCounsellingFreelancing
300108

Begin story discussion1

You

Adewale Walter Aladesuru

Adewale Walter Aladesuru

06/08/2024

For sale?